Wednesday 12 October 2016

Tank Driver Don Put Him Lover For Trouble




Nawa O! See as pipu bad reach? E get one man wey him name be Ekene Ofoegbu and him be Tank Driver for Northbridge oil kompany, The man just get job for the kompany as driver and na him galfriend help am find person wey stand as guarantor before the kompany give am the job.
The galfriend name na Joy and the guarantor name na Kelani. The tori happen one early mormor when dey call Ekene make him go supply 40,000 litres of diesel for Port Harcourt but till today him never reach d place and dem no sabi where him dey. Na so the kompany kari police go arrest the galfriend with the guarantor. The kompany talk say all the thing wey Ekene kari reach N7.2 million. The police don interrogate dem sotay dey kari the mara go court.

The galfriend with the guarantor talk say dem no sabi anything wey happen o, say dem sef still dey konfuse. As e be so, the presiding magistrate don grant dem bail of N2m each with 2 surety wey go pay the same amount. They still dey prison as we dey yarn so, bkos dey no go fit see dat kind money to bail their self. Nawa o!!!


No comments:

Post a Comment