Sunday 27 September 2015

See President Buhari United Nations Yan For Pidgin English

Buhari Addresses World Leaders

Konfam pipu our presido don go United Nations Assembly for New York to follow leaders talk how we go take solve problems wey dey affect us for inside this nation, No be only him follow go, some politicians and other dignitaries join body follow am sef, dem reach like 27 pipu. we go break down him opening address wey him yan for dia:


" Ehen,,beta pipu dem, fine bobos and babes I welcome una to dis konfam event o. I wan let una know say una try to support us to arrange dis event especially UN-AIDS, una try wella...

We don reach that stage as leaders to dey kari Millenium development goals. E don reach 30 years wey HIV dey show us pepper for we kontry. Even sef plenty shildren no get papa and mama again plus our community don scatter on top d matter, dat one no reach sef d tin don spoil market for 9ja,

As e b so those sand sand kontry for Africa dey suffer am pass o, But God don help us bcos the global community don join hand to arrange the matter so dat plenty pipu no go kaput

The tori never finish o, we don try do sum kind tins so dat mama bonboy no go transfer HIV give her pikin. For 2014 e pass 3million pipu wey kari belle do the HIV test but na 63,000 get chance to see doctor. Beta pipu, fine bobos and babes,

The tin wey we need inside dis fight against HIV be beta health care, education and anti retroviral drug wey no cost at all.We kontry go chuk eyes well well inside medical care and we go join hand with all the pipu wey go helep us. We go like make chemist dem dey help so dat the drug wey pipu go use no go too cost. Konfam pipu,

9ja no go stop to dey work with the beta pipu wey wan make we kontry beta. 9ja still dey committed to the Roll Back Malaria tin wey dem declare for 2002. We don declare other tins wey go helep us fight HIV and AIDS for inside Africa for the year 2030. The declaration wey UN yan for 2011 against HIV and AIDS still dey ginger our moral

9ja dey thank una well well for una support as una dey help us to komot HIV/AIDS, Tuberculosis plus Malaria, make we no forget other sikness wey dey kill person like Ebola

I dey ginger una to dey do all d tins wey una fit do to fight small pikin and mama death, HIV and AIDS, Tuberculosis plus Malaria, make we no forget other sikness wey dey kill person

Make we work hand in hand to komot HIV and AIDS kpatakpata for year 2030.

Thanchu very much

No comments:

Post a Comment