Friday 9 October 2015

Ebola Update


Konfam pipu, no be small matter o. The ebola wahala wey just happen for University of Calabar Teaching Hospital still dey hot o, as effribody now dey fear weda the thing na true or na lie.
As e be so, dem don quarantine 15 people for the hospital including doctors and nurses wey dey there when the patient enter the hospital both pipu wey look the patient and the pipu wey touch am. Make we pray say no be ebola o, because the thing wey happen that last time no be small thing o. For those wey prefer salt make una go buy plenty keep o, and those wey like sanitizer, u sabi wetin una suppose do nah....Make God help us o

No comments:

Post a Comment