Monday 10 October 2016

SEE HOW MAN TAKE USE HUMAN HEAD DO BUTTER FOR BREAD

Suspect with human head sandwiched inside bread
My pipu wetin eye no go seee for this change period wey we dey
Police don catch one 24 years old Jamiu Alabi and 32 years old Yemi John on Saturday for Church Bus Stop ipaja, Lagos State wey use human head do sardine for inside bread. They even get mind put price on top am and the name of people wey wan buy am. They put for one bread Danjuma N20,000, another one get Yusuf 70,000 and the last be for one Alhaji Mumuni N10,000. Na wa o, my prayer for una be say our head no go be sardine for anybody bread o.

No comments:

Post a Comment