Monday 10 October 2016

I NO DEY USE JUJU O!!! - AY

Popular Comedian AY don come outside talk say him no dey use juju oooo. Him talk say bad belle pipu dem don dey do mouth chom chom chom dey talk say him dey do juju bcos anything wey him put hand inside dey make sense die.
AY use mouth talk say na lie o, nothing like juju for him side. Him talk say na baba God dey do am for am. 30 days in Atlanta abi na Alanta enter Guinness world record, him comedy show for TV make sense die, even the new fim wey him do, Trip to Jamaica come enter brain finish so tey pipu vex come outside dey talk say wetin sef! na only AY dey dis industry? But the popular comedian talk say him ni dey do juju, say na baba God dey do am like so.


No comments:

Post a Comment