Friday 14 October 2016

Look SS1 Student Wey Komit Suicide Bkos Im No Pass Exam

Image result for ss1 student commit suicide 

Hmmm dis life nawa o. E get one SS1 girl Mojisola Aboola for inside Kwara State wey go drink poison bkos say she no pass the final exam wey go make am enter SS2.
The poison wey she drink come dey worry am o, na so the mama kari am go shush but as the thing come worse na im d mama kari am go hospital and na for there she take die. Life na jeje o, if person no pass exam, e no mean say the person no go make am for life o! Make pipu stop to dey kee kee dia-sef bkos of small small matter.

No comments:

Post a Comment