Plenty pipu don call me to ask one kweshion
Wetin person fit do to survive dis Naija
wey we dey so….
Last week, one of my padi be talk say he
need money to buy Lappy…haba…when I no dey play Baba Ijebu…
Anyway sha, I bin give am Half of the money
sha make e no think say I be bad friend…but I come call am one corner…sit am
down like say he wan do interview come advise am how to make small change for
him pocket…. Dis na wetin I tell am….
1. Know wetin you get passion
for:
When I bin dey small, I
sabi dance well well…infact for my sleep I dey always dance..if I dey waka for
road nko? Pipu think say I don dey get skoin skoin…but them no know say my
passion na to dey dance…I bin reason say if time don reach, I go just open my
dance school for my kaba make dancers fit troop in…but today the tori dey
different.
I bin give up that
year…nobody dey to encourage me…so the thing bin just comot…
So I bin dey yan, anything
wey you get passion for wey go fetch you money wey good ….I no talk say make
you go dey tiff ooo…ehen…the thing wey you like to do no go ever taya you..as
you dey do the work you go just dey smile…
So if you never get wetin
you like to do, go pray and go discover yourself or beta make you follow pesin
wey get brain reason so he or she go fit guide you…
2. Go learn work:

Pipu dey always thinks
say once you don go univasiti, you don arrive…hahahaha…na OYO be your case…for
your information,many pipu wey get first class for school still dey aus dey
find work….even if them get work, the money wey dem dey pay for this our
companies dem no just make sense again…e be get one guy wey sabi English well
well for my department for school…na him dey answer question pass but when we
graduate, he no graduate…ohoooooo…u see? So my broda I no talk say school no
good ooo, I just wan ask you one kweshion…WHAT IF NOTHING LIKE SCHOOL NO COME
EXIST BEFORE NKO? Na so you dey house dey complain?..
Think am ooo…NO FOOD FOR
LAZY MAN..
Bill Gate na school drop
out..
3 Waka with beta pipu wey fit help you make am:

Dis popula adage talk say
‘show me your padi and I go tell you the person wey you be’…
My padi, you gots to dey
waka with responsible pipu…pipu wey go help your career…wey go encourage
you…make your life beta…wey go show you way…wey go fit help you…ehn…you no need
beta counselling…all those pipu wey dey always do aristo no dey help you…no
folo tiff ooo, yahoo yahoo, ashewo, even aproko pipu dem cos na dem no get
work…lol…
4 Make you take Prayer back am:

If Baba God no dey
involved, we just dey deceive ourselves…For every hutle wey we wan embark, Baba
God must dey oooo…sebi Reekado Banks sing am ‘OLUWA NI’, TIWA SAVAGE SEF sing
am ‘IF I START TO COUNT, THE TIN WEY BABA GOD DO E NO GO END…’..my broda and
sista, God must dey involved…If you like go dey depend on your Uncle or papa…I
f God carry them away nko? Ohoooo…
Make God bless our Hustle.
5 Make you take that step now!!!! Time no dey wait again oooo…
Till I come your way again
tomorrow on this ogbonge platform
KONFAM ADVISE
You fit add me for FB
akinseye simi
Or IG @akinseyesimi
No comments:
Post a Comment