Thursday 13 October 2016

Fear Grip People As Person Wey Die Wake Up For Im Burial

Image result for surprise
My kofam pipu, fear don grip people for Warri, Delta State as dem be wan bury one young girl wey don kpai.
Na so she stand up, like say nothing happen o, we hear say the girl don carry belle and dey try to remove am when she quickly go meet im ancestor. She drink concoction wey she wan use commot the belle, the thing come make am sleep like say she no go wake again. so pipu come wan bury am as she no wake. As dem bury am pour sand, she come sneeeze and shout, everybody pick race o, dem don carry the girl go one Christ Mercyland Deliverance Ministry for deliverance. Miracle still dey happen o my pipu.

No comments:

Post a Comment