Konfam pipu, my prayer be say we no go dey Hungry as everything dey put money on top for this recession period.
Na for Vanguard we get this information say those wey get bakery under the Association of Master Bakers and Caterers of Nigeria (AMBCON) go soon put more money on top the current price of bread wey go start from October 17. Dem don talk say the things wey dem use do bread don increase and e dey affect them well well, so dem no get choice than to add money join everything. Make una see the new price of bread.
PRODUCT OLD PRICE NEW PRICE
Small Bread(The one wey dem no slice) N70 N80
Big Bread (slice) N250 N280
Biscuit N10 N15
Cup cakes N50 N60
Big Cake N3500 N4000
No comments:
Post a Comment