You sabi dat lepacious friend wey you get abi? Plenty lepa pipu don dey cry say pipu dey like to harrass their life with some kind yarn but we don arrange the yarn for down, look dem...
1.) Come O! You Sure Say U dey Chop At All?

No I no dey chop, I dey do fasting, mtchewww.
2.) Come My Pikin Talk True, Dem Dey Maltreat You For House?
Yes aunty dem dey maltreat me o, abeg find me shikini money abeg... :-)
3.) Omo See As You be Like Broom
I Know nah dats why I dey APC....
4.) Why You Too Dey Stingy, You Be Akagum.

Thank you God bless you...*crying* *sniffing*
5.) Where All The Food Wey You Dey Chop Dey Go?
E dey go ya head...waka
6.) You Don Thin O, You Dey Fast Abi?

Yes na 365days fasting wey dem declare for my shush....mugu
7.) See The Thing Wey You Dey Chop And you Still Be Like This

As I dey look you sef hungry don dey catch me.
8.) Sometimes I Dey Wish Say I Fit Be Like You

U Donminit!
No comments:
Post a Comment