Life Na Jeje:
How many money you wan make wey you wan dey keep trillions
for inside one cupboard?
All these things go show at the right time.
Some pipu, especially our youths dey always do ritual bcos
of money, some dey go babalawo house…na wa oooo.
Na for facebook I see say one boy wey kill 2 year old pikin fold am like
cloth come put inside bag and many other tori dem
See no forget say, anything wey you do today, tomorrow dey
ooo…like our former first lady go talk.
DARIS GOD OOOO….
Abeg try dey exercise PATIENCE…
Baba God go bless our hustle oneday!!!

Life no be
competition:
If your broda marry at age 28, e no mean say na that exact
age you must marry nah aba!!...as dem talk all fingers no dey equal … make you
dey learn to dey patient and make money at the right time…
Everybody dey guilty of that thing wey we dey call
competition:
-Parents dey compare pikin with another pikin
-Husband go dey compare him wife with him neighbour
wife..haba!!!
-Teacher go dey compare person wey sabi book with person wey
no too sabi book..kilode?!!!
-Even for office nko?..oho oooo
But one thing wey I like about Usain bolts be say, he sabi
say he get long leg like ostrich that na why he go dey win all those runners
wey get yam leg…lol ..na joke I dey ooo.
If na your time to shine, you go shine…..and when time don
reach , nobody go fit stop you.
No envy anybody..just dey do your own and back am with
prayer…I fit assure you say papa God no dey sleep

This na the shikini advise wey one writer bring come for una today, you fit follow am for :
IG: akinseyesimi
FB: Akinseye simi
Twitter: @ijosimi1
If una get any yarn wey dey like dis one or any tori wey dey happen for una area sharperly send am go konfam9ja@gmail.com
If una get any yarn wey dey like dis one or any tori wey dey happen for una area sharperly send am go konfam9ja@gmail.com
No comments:
Post a Comment