Wednesday 10 February 2016

WARNING!!! How To Know If Your Boo Has A Boo

 
Konfam Love pipu, abeg make una shine eye well well dis valentine period o, bcos that ur boo fit get anoda boo for somewhere ooo! Make we look sum tins wey go make you sabin weda ur boo na ur boo or anoda person get am. Shine eyes for dis mata o...


Number One: 
 Your boo na ur boo if he/she no give you any excuses at all on that Feb 14. Except say the person dey far well well, but if the person no call you that day for at least 5 minutes to express his/her love that ur boo get a boo somewhere oooo!

Number Two:
If your boo dey demand pass wetin u fit afford, dat one na aristo oo. A real boo no go wan trouble u too much bcos d person go love u die! If your boo dey even threaten u ontop the demand make u carry ur two legs vamoose sharp sharp, dat boo no be ur boo oooo!!!

Number Three:
Your boo no get ur pinshor for fone, even sef u go beg am make una snap and after dat u no go find the pinshor for his/her fone again. That ur boo na olosho o, get anoda boo now!

The list plenty make we take style match brake for here. watch out for more tips and shine una eyes wella make ur boo no give u high blood pressure. Love U!

1 comment: