Wednesday 10 February 2016

VALENTINE EXCUSE WEY NAIJA GUYS DEY USE




Konfam 9ja babe, see lie wey naija guys dey give to miss valentine with bae.
Abeg make una open una eyes and ear well well. Na now u go know if that your bobo na correct one


1. Armed Robber Attack: Na around this period robber dey attack naija guy collect them fone, wey be say he go dey switch off till 15th February, as e go tell u say e just retrieve im line. Na around this period dem dey change phone sef.

2.Busy: Na now them dey close for office by 1:00am and they dey claim say they dey too busy, they go beg the babe, tell am say them go make it up. Bae, please kindly go meet am for office, do the work with am and do valentine if e don finish, no dull.

3.Broke: when bobo don dey give u red light, dey talk say e no even get money for airtime, e don dey indirectly tell u say valentine no sure. Abeg find business give am sharperly

4. Network Failure: This one sef dey, na now im ping and calls no dey go through. my lady, abeg pack your things go meet am for house. u no need the network at all.

No comments:

Post a Comment