Saturday 10 October 2015

LWKMD-Thief wey No Sabi Thief

File Photo of customers waiting inside a banking hall 

Hahahaha, nawa o, make una see this matter wey happen for GTBank Ilorin, Kwara State. As customers dey wait for line na so one thief just komot for roof fall for ground.
The matter be say the thief been wan follow roof enter the bank but no way to enter and him come dey there dey wait him second but that one no show. Na so the man dey there reach morning o, as the man fall the pipu just rush am for ground cum hand am over to police. As e be so, commissioner of police go the place to know wetin happen and dem don kari the thief for investigation. Nawa o...

No comments:

Post a Comment