Saturday 3 October 2015

Diezani Alison-Madueke Don Enter Wahala O


Konfam 9ja pipu una don hear the latest gist abi? The tori wey dey effribody mouth na the Arrest of former minister of petroleum Diezan Alison Madueke, for UK by the UK National Crime Agency for bribery and Corruption. Nawa o! na God go help us for dis kontry.
As e be so, EFCC run go block her apartment for Abuja were she dey stay, dem even dey there reach this mormor. E neva finish o, dem don go arrest her business partner Jide Omokore wey dey stay Lagos, dem even talk say him wife dodge go hide as she see the EFCC pipu for their dormort. Efribody dey wait make Diezani come back to 9ja, but UK never finish with am sha, although dem don bail am from police station but she go-go back on Monday for plenty question.

No comments:

Post a Comment