Saturday 3 October 2015

Ministerial List Still Dey Efribody Mind


Konfam pipu una good morning o, how una dey today na, make we take style look the ministerial list tori wey dey for efribody mouth dis days. As e be so, effribody fold hand dey wait for Senate presido and him pipu make dem start plenary on Tuesday so dat dem go open the list wey oga Presido Buhari send give am.
Still on the mata, some pipu wan make President Buhari choose 42 pipu for ministers while others dey talk say make him follow 1999 constitution wey talk say 36 pipu suppose to be ministers. Weda e go be 36 or 42 pipu go dey there, but no forget say na only 21 names Buhari send go give senate, the remaining nko? As e b so, different pipu don dey lobby for the remaining slot. We don sabi some pipu wey go finally enter as ministers but wat of the remaining pipu, who you think say go enter the remaining list? Talk ya mind...

No comments:

Post a Comment