Thursday, 24 September 2015

Native Doctor Go Sell New Born Baby For N300,000

Onalaja, Oluwakemi and Dele
Native doctor and the pipu wey buy the pikin

Konfam Pipu dis one happen inside Mile 12 area for Lagos. The native doctor Olawole Onalaja, kari pikin wey just reach one week go sell give Dele and Oluwakemi Ayangbile for =N=300,000. The main person wey get the pikin, Idiat Babatunde, be relative to Olawole wey be the native doctor and she be student of one polytechnic for Osun state. She wan travel go do her convocation, na im she cum tell Olawole make him family help am take care of the pikin. But the man cum kari d pikin go sell give Dele and him wife bcos dey no get pikin. Weda na miracle him dey try perform for dem we no sabi dat one. But as e b so d landlord for d haus wey Dele and him wife dey stay go report to police say him dey hear pikin wey dey cry for dia haus and him know say dem no get pikin. As e b so police don package all of dem.


No comments:

Post a Comment