Konfam football fans, Hope say una dey support our 9ja boyz dem wey dey showcase dia talent for d premier league.
As e b so, Victor Moses of West Ham don be hot cake as him take help him club win d match against Man city. Kelechi Iheanacho dat Ibo boy still dey on fire as him take settle d mata for d match wey Man city Play against Crystal Palace. Odion Ighalo of Watford Fc na anoda konfam naija player wey no gree dull for d premier league as him help dem flog New Castle 2-1. D premier league still dey hot, we go dey yan sum new tori on top d mata.
No comments:
Post a Comment