Friday 7 October 2016

WE WANT OUR JONA BACK!!! EBONYI TRADERS CRY SAY THE ECONOMY DON TIRE DEM




 Traders wey dey Abakiliki main market for Ebonyi state, dey cry say na only former president Jona fit end the thing wey dem dey face for this Buhari era.

Ebonyi trader don carry Jona poster everywhere say them still love am well well. E be like say Nigerians don tire and come even dey find solution anywhere anyhow. The information wey we get from punch talk say, since e don reach one and half year wey oga Jona comot office, him poster still dey show for Ebony market. Make God help us bring the kind change wey we want o. 

No comments:

Post a Comment