

Na so we hear am o Konfam pipu, na one aboki give another mallam direction say e dey go Oshodi. Na for Jankara market, pipu see the two aboki dey argue seriously come ask wetin happen. The one wey give direction talk say im still dey live but im manhoood don dey walka comot as the thing dey smaller than how e take be. Pipu even beg say make any woman help am massage the thing if e go big back or maybe the man wan add join the one wey e get before. The man dey cry say the other Aboki don use juju tifftiff part of the john Thomas. Make we dey careful now, make our thing sef no go disappear cos we wan help our brother.
No comments:
Post a Comment