Monday 10 October 2016

MEET THIS MAN WEY DON TURN PRISON YARD TO IM HOUSE

Emmanuel Oyewunmi is going back to his home

My konfam pipu meet Emmanuel Oyewunmi, a 41-year-old indigene of Ikale in Ondo State, don dey road to prison again on top say im steal phone and money. Na Guardian talk am o.

Oyewunmi don go prison three times this year, dem arrest am for Ojodu Berger on Friday, October 7, 2016, for Ojodu Berger Bus-stop after im tiff phone and N600  from a bus driver and a passenger.
According to the police, Oyewunmi don dey wanted for RRS list after e tiff one Samsung Galaxy S4 wey belong to one  Adesewa Oni while he dey work as park keeper for outside the Shoprite Shopping Mall in Ikeja.
Oyewunmi don confess say:
“Dem push into tiff tiff cos he dey take hard drug. im say as he tiff the phone, na sell im sell am to buy hard drug. E even sell the phone for N8000.
E dey beg say im no wan go prison, say im need forgiveness. My konfam people, forgiveness go be for prison o. we no wan join this kind thing put for wetin dey do this country.

No comments:

Post a Comment