Passengers dey see plenty tins o. Make we take style look some of the things wey passengers dey experience for inside public transport...
1.) Passengers wey go dey fight to enter bus the same time...no patience at all
2 .) Person wey go mess inside bus dey pretend...Diaris God OOO!!!
3.) Driver wey go kari passenger pass him bustop...bet driver shebi I tell u nah?
4.) Some passenger wey be like tif go kari nyash come sidon near you
5.) Conductor and Passenger wey dey fight...who go win?
6.) Marketers wey dey sell medicine with pastors wey dey preach...nawa o!
7.) That passenger wey dey like to chuk eye inside person phone...bros mind ya bizness nah..mtchew
8.) Conductor wey no dey ever get change
9.) The passenger wey sabi komplain... ahn ahn aunty why u no enter Uber nah?
10.) Passenger wey go sleep sotay them go use person body do pillow...oga na bedroom you dey?
No comments:
Post a Comment