Wednesday 23 September 2015

WINCH WINCH AUNTI WAN USE SISTER PIKIN DO SALAH RAM!


na wetin we no go hear for this naija, demonic aunti don sell im sister pickin for small money
konfam pipu, na one wicked aunty carry im sister three pickin say she wan buy biscuit wey dem go chop, pipu no no say na sell she wan go sell them. she carry all these pickin from kaduna, come drop the senior one for Abuja-Jos expressway, say she go quick get im parole. she come go sell the remaining two for 600 000 thousand,
Na pipu see the senior pikin wey be 13 years old dey waka up and down come ask am question, she tell them everything, na so pipu call  police wey come catch the aunty. she don confess say dem plenty wey dey do the business, police don dey on top the mata. Abeg make una keep una pikin well well o.

1 comment: