Monday 21 September 2015

Nawa O! See As Devil Take Use Person Dey Work O


Konfam pipu, una hear d one wey just happen? E get one man wey dem dey call Nelson Oamen, wey dey stay Ipaja area for Lagos state. Dem tok say dis man get craze for head bcos him dey smoke igbo well well. But as e b so, him enter haus take knife chuk him 74 years old papa wey get stroke, komot d man heart vamus. Na d sister raise alarm d time wey she see d papa dead body for room. As e b so, Police don dey find am. Dis life nawa oooooo.....

No comments:

Post a Comment