Thursday 17 September 2015

FOOTBALL KONA!!! MESSI DON START AGAIN O!




Konfam!!! on 16th September 2015, Messi break record o. Him don kolet title for youngest player wey don show face for 100 matches inside UEFA Champions League.


See as him take dey pose for pinshor sef, Life is Good. Lionel Messi, since d day wen him first show face against Shaktar Donesk for December 2004 don win four competition and him don score 77 goals. make una nack am beta klap jare

1 comment:

  1. messi my man.... this tin konfam... nna ehn... odika very frosh

    ReplyDelete