Thursday 24 September 2015

Boko Haram Wan Attack Lagos O!



Konfam pipu, d tori wey we see inside Vanguard be say boko haram wan take style enter Lagos and dem wan follow Seaport. National Security Adviser (NSA) office don dey alert pipu say dis bad pipu wan follow seaport attack Lagos o.
Port facility security officer forum don yan all dia members make dem open eyes well well dey watch incase anytin wan happen. Custom officials dey warn effribody make dem dey shine dia eyes, bcos as e be so, e never tey wey dem catch one Abdullahi Adamu, wey be member of the boko haram pipu. Make God help us o!

No comments:

Post a Comment