Plenty pipu no sabi the name wey dem dey call dis popular fruits, make una take style look the arrangement wey we put for down....
1.) Plenty pipu dey call dis one ofio but dem no sabi the konfam name. The konfam name be Tiger nuts.
2.) Even pipu wey go school no sabi dis one sef. For 9ja we dey call am Fruit but the konfam name be Tropical almonds.
3.) Lickie Lickie...talk true even you wey dey read no sabi dis one sef. Effribody dey call am lickie lickie but the konfam name be Black Velvet Tamarind.
4.) The last one wey we go yan about nah Udara as ibo pipu dey call am or Agbalumo as yoruba pipu dey call am. The konfam name be Africa Star Apple
No comments:
Post a Comment