Wednesday 19 October 2016

Look This Woman Wey Send Boiz Go Kill Im Husband

 

Nothing wey person no go see for this life o, e get one woman wey send boys make dem kill im husband for inside Lagos. The tori be say the woman give dem N500,000 for the job, but as dem dey try kill d man dem no succeed.
As dey see say them no fit succeed, na so one of dem come talk say him go enter the haus go tif. As the man dey try climb fence one amebo neighbour come raise alarm, na so security hold d man o. The man come confess say na the woman send am but the woman no gree, she talk say na beat she send dem make dem beat the husband o, say she no tell anybody make dem kill am. Dey come ask the woman why she wan kill her husband, na im she talk say na bkos the man no dey gree do am well o, say the man dey beat am anyhow for haus. Weda na true or na lie we never know. Thank God for the man o, chai! some pipu wicked o!

No comments:

Post a Comment