Tuesday 18 October 2016

Husband Talk Say Im Wife Dey Carry Man Come Their Bedroom

One business man wey im name na Kingsley Agina don go court say e wan end im 10 year marraige on top say im wife dey sleep with different men for their matrimonial home.


Image result for black Africa woman carefree
Agina don talk say im wife ways no pure, say na ashewo as she dey bring different man come sleep for house anytime wey e travel out for business. E talk say one time wey e travel come back, the dinning table don braek, e ask im pikin, that one tell am say na one uncle wey mummy bring break am. Agina don also talk say one time wey im bed dey shake, e call carpenter and when e check under the bed, na tissue full there. E no finish for there, e talk im wife don dey poison am small small, say na 5 million Naira e use go hospital and e never still dey alright. he said the girl mama get juju and na she dey give im wife  to kill him.
This mata na wa o as the wife don deny am o, say na the man no dey responsible as e dey carry different girls come house, say she don give am condom as e no stop so e no go bring infection come house. She say why she go kill the father of her four children and make dem beg Agina say she no wan end the marriage and finally say she dey faithful and she no dey carry im money give man o. Court don shift their mata to another day. E be like say one of the couples dey lie, but we no even know.




No comments:

Post a Comment