Premium Times don talk am say, dem don catch 2 soldier with money wey dem pay as ransome to release the wife of CBN Governor along the Benin-Agbor Road on September 29, 2016.
The suspects wey reach 12 chase Mrs. Emefiele’s security inside bush and carry madam go until dem rescue am.
Police come talk say they find 15 million and a Honda Accord car for the soldiers hand and dem be students for Nigerian Army Institute of Technology and Environmental Studies in Makurdi, Benue State. Na for these recession period wey we think say we dey safe, na im some bad egg wey suppose protect us dey do anyhow.
No comments:
Post a Comment