Tuesday 11 October 2016

CHURCH MEMBER DON USE STONE KILL PERSON HUSBAND

Image result for SOMEONE STONING SOMEONE TO DEATH IN NIGERIA

Na wa my konfam pipu, na wetin dem dey even teach for some churches, shey na violence or peace? Na wetin come my mind as I hear this news, on top fence demarcation mata, na im church member view stone one man until life comot for im body.
This one happen for Amebo-Ndebo wey dey Ebonyi state, na pipu talk say the man wey dem dey call boxer or coach get small quarrel with some church pipu over fence mata. Before we know am, na the wife hear noise rush outside see say im husband don kpai. Police don arrest the person wey get hand for boxer death.

No comments:

Post a Comment