Konfam pipu, wetin dey happen to 9ja Police nah? Dis tori dey fit make person kari body komot 4 dis we kontry. One man wey him name na Godwin, dey hospitu as we dey talk now,
but him wife don kpai bcos police waste bullet for dem body. Dem bin just komot for shush as dem dey sing halleluyah dey go haus, police dey road dey ask keke drivers make dem drop sumtin 4 boys, but as Godwin see dem him tear speed, na him one police take vex, skata bullet for him own keke, na so him wife take kaput o. Wetin we go do dis Police pipu dem?
No comments:
Post a Comment