Konfam 9ja pipu, efribody dey wait Bayelsa for the governorship election wey dey come on d 5th of December 2015. As e b so, PDP don finish their primary election and the present governor Dickson Seriake don komot as d winner.
APC still never talk their own bcos the one wey dem do still dey cause serious gbege. Former governor for the state Timipre Slyva don come outside talk say the election committee chairman Adams Oshiomole wey b governor of Edo state no do well at all for the primary election but Oshiomole sef come talk say him send area boys to come block am for the stadium were dem dey do the election. As of now we never know their result but our eyes dey open make we dey watch.
No comments:
Post a Comment