See the way wey police take arrange beating for one monarch pikin
Konfam pipu, we don tire for the kind thing wey we dey hear for we country. According to Daily Independent Report, police officers wey dem attach for Area C Command for Surulere don show one monarch son pepper, come lock am up for cell join.
The boy wey im name na kelvin Ekeh, the pikin of Eze George Ekeh who be tradition ruler of Ubomiri clan for Imo state, go do small shopping for yaba when all these things wey he no expect happen.
The boy talk say, police just come package am for their motor like sardine, beat am tire, collect him phone and even naked am join, say make im agree say he be criminal. he say dem come later collect 50,000 wey he wan use do shopping.
Eze George Ekeh don call IGP to investigate those wey do im pikin any how. Hmmmm my pipu, make we dey pray say make trouble to come meet us for where we dey oooo.
No comments:
Post a Comment