Friday, 25 September 2015

3 TRICKS WEY U FIT DO WEY GO MAKE UNA SEE SALAH MEAT CHOP


Konfam pipu, if u neva chop salah meat, hope still dey for you today, follow these tricks and e go shock you how meat go poku for u
Konfam pipu hope still dey if u never chop salah meat as  dem dey contnue the salah jollification today. If u no get muslim friend and salah meat dey really hungry you, make una follow these tricks:

# Try wakabout small, anywhere u see say dem dey kill ram or na muslim, try greet the pipu wella, make the greeting different from the one u don dey do before. you fit come use style ask dem how salah dey go. No how, if u flow with dem,  ram sure for you die.

# Try visit your facebook page, check for your muslim friends and contact dem. Una no au u fit tell dem say u wan come dem side.

# Try help you Muslim neighbor as him dey try do preparation for the ram wey him buy, if dem no get matches or lighter, just volunteer. Crime no dey there, swallow pride and salah meat fit be your own.

IF U NO CHOP SALAH MEAT THIS YEAR, UNA DON MISS BE THAT AND NA TILL NEXT YEAR.

No comments:

Post a Comment