Friday 25 September 2015

Hajj Stampede Don Kaput Two Beta Nigerians

Hajj victims

Chai! Konfam pipu, the tin wey happen for Mecca don kari our beta pipu for 9ja. The woman wey ddey the picture na Hajiya Bilkisu Yusuf and she be First female editor from North of 9ja. And the Man na Professor for University of Maidugiri him name na Tijani El-Miskin.
The tori wey cause the death of 717 pipu wey go pray to Allah for Mecca be say, na the time wey dem start to stone the Devil na him pipu cum dey run and those pipu cum die for the place. May their soul Rest In Peace

1 comment: