Wednesday 12 October 2016

THE KAIN BABE WEY WE MUST AVOID FOR THIS RECESSION PERIOD!!!

Good day my pipu, dis na the  ogbonge segment wey I call’ Konfam Advise’.
Na page wey we go dey talk the thing wey we suppose do as things dey happen.

This thing wey we wan talk dey always pepper man…some men no gree sleep bcos wetin our Naija Babes don turn themselves to for this recession ehn e fit make person get HBP


So my advise for  dis segment be
THE KAIN BABES WEY BACHELORS MUST AVOID FOR THIS RECESSION PERIOD:
1-      SHAWARMA/ PIZZA BABES:
I no know wetin concern agbero with overload…the rate which our Nigerian girls dey order shawama  dey do me gbish gbish…make I  give una one gist…I been carry one babe comot just last week..na in the girl say she wan go one eatery I say no wahala….as proper Lagos boy with 5k for pocket, I talk say no yawa…when we come finally reach, I no know say 2 of her friends dey wait us already courtesy of BB…come see as I dey sweat…but thank God say I no carry last…
 Image result for african lady eating shawarma

2-      I DON’T HAVE DATA BABES:
Abeg I wan take this moment tell all these our telephone company dem say make dem dey calm down for all these promo wey dem dey do.
If you dey follow babe chat and she complain say her data don almost finish, abeg delete am shapely…she dey find DATA  Mugu…
Now make I explain am….If you take your korokoro eye go all dem Instagram page , na so so video dem go dey upload….eg  THE TIME WEY DEM DEY  PESIN INTRO wey dem no invite am, the one wey dem dey TWERK, or the one wey dem dey CLUB, some don dey put flower for dem head…no wonder if we look naija road, no single flower..na soso dust full road…
SO my broad if you know say you wan marry am, you fit dey send to am…but if you no wan marry am, hmmmmm….naija babes dangerous oooo…
Beta tins dey wey we fit use money do…MONTHLY DATA NA BAG OF CEMENT…abeg we must plan our future weda dem like am or not….

Image result for african lady holding android phone
3 BABES WEY NO GET WORK:

My broda, hmmmmm….this one na the best advise…any girl wey dey chat you for Monday morning abeg no reply am…even if you reply, ask am where she dey?...if she talk say ‘Home dear’, quickly delete am…or if you wan still follow am chat, ask am when she been graduate…if she talk say 2 years ago, ask am wetin she dey do…if she say ‘ NOTHING’, my broad…she no be wife material…block am…lol…now make we comot for Joke matter… for this recession, babes got to go look for work oooo…no dulling…and as bachelor we must shine our eyes make we no come dey talk as oyinbo dey call am ‘stories that touch’…na time to save money…any babe wey talk say make you dey buy buy…biko broda  carry your K-leg run ooo…
Image result for jobless african lady


4  BABES WEY DEY CHANGE HAIR EVERY WEEK

Image result for african lady with big afro

5 BABES WEY TOO DEY FRUSTRATE PERSON LIFE WITH YAB (BABES WEY TOO STUBBORN)

 Image result for nagging african lady

We  still get beta babes wey dey alright oooo but you must to shine your eyes oooo…
God bless all the bachelors wey wan make this our country beta…
And una bachelors wey dey carry different colours of babes for this recession, OYO na your case.

Na everyday you go dey see beta advise for this Konfam page.

You fit follow me on IG @akinseyesimi
Or FB Akinseye simi








No comments:

Post a Comment