Saturday, 26 September 2015

President Buhari Administration Dey Slow Market For Private Jet Companies



Konfam pipu una don hear am? As pipu dey celebrate d fight against corruption  some pipu no like am at all at all. As e b so, pipu wey dey do plane charter  business dey cry well well say dis Buhari adminitration no favor dem at all bcos all d top pipu for the kontry no dey gree patronise dem again.
Dem say if na before u go see plenty pipu wey dey cum charter private plane, helicopter and jet to dey do dia waka waka but as e b now, all of dem don dodge. Maybe dem dey fear say Buhari go probe dem, we no talk anytin o, make we sit down with a bottle of orijin dey look dem nah..

No comments:

Post a Comment